Intro Abeg! Omo e get weytin i just dey observe ehn for this industry *It’s Victor AD nahnah ye e* *It’s paperboi* Motivate yourself men Area! The Erigma
Verse 1 – Erigga E pain me say na wen I go na hin everywhere burst People wan know if na true dey check Insta blog Prapas dey throw backie happy wan kill dem die As Erigga no dey again people go feed dem die Even rappers wey no dey post my song before Fake love don put me for their profile picture They screenshot their dm wen I dey write dem Say make we make feature see me see problem Followers don increase go 1.5 m OAP since morning dey jam me for Fm My videos wey soundcity no gree accept Dey on every rotation even my concert Na so e for be but oluwa forbid My song go speak for me anyhow e be Who go better go better na time e go take Day break everywhere burst for goodness sake
Victro AD I say tell dem the full story but dem no dey believe o eh No matter how you watch film d story inside no fit change o I be dey give dem the full load down but but dem no believe o eh Who God don bless world people no fit change o
Chorus Area o, area o, area o ehh (Warri to d world) To the world o , to the world o , to the world o eh Area o area o area oo eeeh (Paper boy Abeg!) To the world o to d world to d world o eeh
Verse 2 I remember wen I no get bar That year na wen I dey je ejeba Madam know me just put soup with 5 eba No be enjoyment I come na for survival No where to go wetin man go do Na around 2 we dey thief fuel from people motor Dey sell give who get I pass my neighbour Rechargeable lamp dey listen to to my all man Deebo As e dey give us gist abt all celebrities No internet Na him be out everything I remember when I track am for DBS Give am my jam e no play am e pain my chest Because I know d stress wen I don go through No sponsors sef na money why u save for school Na hin I take record am wetin man go do Give up no join am na ballings
Victor AD I say tell dem the full story but dem no go believe o No matter how u watch film d story inside no go fit change o I be dey tell dem the full load down but dem no believe o Who God don bless world people no fit change o
Chorus Area o, area o, area o ehh To the world o, to the world ehh, to the world Area o area o area o ehn (Abeg! Wahala) To the world o to the world oo to d world
Outro Omo see the character Na only time e go take stammerer go call him papa name